Coutinho just dey cost Bayern Money

Coutinho just dey cost Bayern Money

Tori say Philippe Coutinho dey cost Bayern Munich ogbonge kpogiri wey reach £563,000 a game.

 

According to akproko from Germany, the figure follow inside the 27-year-old annual wage of £21m join the £7m loan money from Barcelona.

 

The total amount also include every game wey Bayern go play dis season as well as all the other cup matches dem.

 

The Brazilian bin complete im loan waka from the Catalan giants early for dis summer after e struggle to break enter inside nnayi ukwu Ernesto Valverde starting XI.

 

Bayern go get the option to make the waka permanent for £100m next summer as part of their loan agreement.

 

Coutinho get two goals and three assists so far for Bayern after 11 games wey e don play.

 

But im form as of recent don see am sidon ontop bench.

If you use the quotes from this content, you legally agree to give www.brila.net the News credit as the source and a backlink to our story. Copyright 2024 Brila Media.

COMMENTS

WORDPRESS: 0

Imageboosterbn
WP Twitter Auto Publish Powered By : XYZScripts.com
error: Content is protected !!