E pain me as I miss 2013 AFCON – Osaze

E pain me as I miss 2013 AFCON – Osaze

B4 b4 Naija International wey be Osaze Odemwingie don carry im boot go hang as e don announce say im don retire.  E make dis announcement now wey e dey 37 years.

Osaze start to represent Naija since 2002 and e get over 60 caps. E don play for two world cups and four Africa cup of Nations come still kolobi silver for the Olympics for 2008.

 

E play for some ogbonge clubs for England like West Bromwich Albion, Cardiff City, Stoke City, etc even sef e don play for France, Russia and even for Nigerian league wen e play for Bendel Insurance.

 

Many people go remember Osas sake of wetin happen wen e wan force movement from westbrom go QPR on deadline day na so the thing come back fire, and the club come later discipline am, e later come out to do public apology.

 

Apart from that one, Osaze bin enter one sokoto with Naija late coachila wey be Stephen Keshi after e comot am for setting for the 2013 Africa cup of Nations although im name follow for the 30 man provisional squad for the World cup for 2014.

 

E later make the final cut go the World cup, come score join.

 

As e dey so Osas dey play for Indonesian side Madura United.

If you use the quotes from this content, you legally agree to give www.brila.net the News credit as the source and a backlink to our story. Copyright 2024 Brila Media.

COMMENTS

WORDPRESS: 0

Imageboosterbn
WP Twitter Auto Publish Powered By : XYZScripts.com
error: Content is protected !!