Ghana don ready wella for AFCON – Captain ‘General’ Gyan

Ghana don ready wella for AFCON – Captain ‘General’ Gyan

Ghana striker wey be Asamoah Gyan believe say dem ready for the Africa Cup of Nations after dem draw 0-0 with South Africa the friend friend gbege wey shele on Saturday. 

The Black Stars dey try see whether dem go fit kolobi their fifth continental title and the first one since 1982.

 

Dem currently dey their final week of preparations for the United Arab Emirates as dem ready for the June 21-July 19 championship for Egypt.

 

The draw soup with South Africa go be their last friend friend gbege as dem don already lose 1-0 kondo give Namibia.

 

Ghana dey the same group with defending champions wey be Cameroon, Benin and Guinea-Bissau for Group F. The team go waka comot the UAE enter Egypt on Thursday.

If you use the quotes from this content, you legally agree to give www.brila.net the News credit as the source and a backlink to our story. Copyright 2024 Brila Media.

COMMENTS

WORDPRESS: 0

Imageboosterbn
WP Twitter Auto Publish Powered By : XYZScripts.com
error: Content is protected !!