Karim Benzema don go back go court

Karim Benzema don go back go court

Tori say the sex-tape matter wey dey between Karim Benzema and Mathieu Valbuena don return to court on Monday.

The Court of Cassation wey be the highest-ranked court for the French justice system,bin gather on Monday afternoon with 19 magistrates to try and settle the case wey first start four years ago.

 

Valbuena bin complain give police for June 2015 after one man wey bin dey find lucrative deal in exchange say im no go publish one intimate video of the player and im girlfriend bin contact am.

 

Dem don indict Benzema since 2015 together with Alex Angot, Mustapha Zouaoui, Younes Houass, Karim Zenati and Djibril Cisse and dem charge dem ontop grounds of ‘complicity in attempted blackmail and participation or inside conspiracy’.

 

But the Real Madrid striker defence lawyers believe say police do mago mago for the shook eye and therefore dem dey argue say make dem drop the case.

If you use the quotes from this content, you legally agree to give www.brila.net the News credit as the source and a backlink to our story. Copyright 2024 Brila Media.

COMMENTS

WORDPRESS: 0

Imageboosterbn
WP Twitter Auto Publish Powered By : XYZScripts.com
error: Content is protected !!