LMC nack Katsina United akpako sanctions

LMC nack Katsina United akpako sanctions

Tori wey dey say LMC don carry akpako Sanctions samma Katsina United sake of say dem breach Fair Play Principles.

Katsina United go now pay fine wey reach N1million and dem fit pursue dem comot go another stadium sake of say dem no gree teams wey come visit to train for their home ground wey dem bin register to dey play matches as the Nigeria Professional Football League (NPFL) Framework and Rules take provide.

 

The League Management Company (LMC)announce dis akpako after dem siddon review the complain wey three other clubs join the one wey Rangers International complain wey say dem no gree dem enter train for the Mohammed Dikko Stadium.

 

Aproko say even MFM, Kwara United, Insurance of Benin and Lobi Stars don also complain of the same thing say “dem no gree dem enter stadium for pre-match training.

 

Under the rules wey dey so, Katsina United get 48 hours to take reply in writing with option to gree the decision wey the LMC take or enter one Sokoto for hearing.

If you use the quotes from this content, you legally agree to give www.brila.net the News credit as the source and a backlink to our story. Copyright 2024 Brila Media.

COMMENTS

WORDPRESS: 0

Imageboosterbn
WP Twitter Auto Publish Powered By : XYZScripts.com
error: Content is protected !!