Messi no sabi tok

Messi no sabi tok

After Lionel Messi open mouth to tarsis Organizers say dem bin set up the Copa America for BRazil to kolobi , na so Selecao coachila wey be Tite don provoke come out to para for the Barcelona Star say e need to show  respect and gree say dem beat am instead of to dey yarn apata anyhow.

 

Messi dey when Argentina bin lose give Brazil for  the semi-finals, before Refree come giam Red card for the kasala against Chile for the third-place play-off, Messi bin suggest say the Officials dey favour the host wey be Brazil throughout.

 

True true Brazil kolobi the trophy wey go be their first Copa America since 2007 after dem kpokpo Peru 3-1 for the final with their coachee declaring say Messi no get right at all to tok say na mago mago dem use kpake the cup.

Even though say Tite no happy with the way wey Messi carry dey yarn anyhow , e say the referee no suppose pursue the Argentine skippo against Chile.

 

The 32-year-old bin go physical with Gary Medel for the first-half and the two of dem follow collect straight red cards.

After e carry Brazil go kpake the title for home soil, Tite don become the first manager ever to kolobi the Copa America, the Copa Libertadores and the Copa Sudamericana.

If you use the quotes from this content, you legally agree to give www.brila.net the News credit as the source and a backlink to our story. Copyright 2024 Brila Media.

COMMENTS

WORDPRESS: 0

Imageboosterbn
WP Twitter Auto Publish Powered By : XYZScripts.com
error: Content is protected !!