Na fight to survive for Sunshine stars and Rivers United

Na fight to survive for Sunshine stars and Rivers United

Sunshine Stars Don continue their ginger ontop the NPFL table as den kolobi 1-1 draw against Rivers United for Port Harcourt on matchday 16. 

Both teams enter the gbegerism with goal difference wey separate dem ontop the table and dem dey just one above the relegation water and dis one means say na maximum points both sides need to carry dey safe.

 

Na Ajibola Otegbeye penarity kpake the vital away point for the Akure base team after the hosts bin take the lead via Penarity too.

River United bin get Penarity for the 69th Minute  and Ossy Martins come step up to make sure say e keep the home side for front but kasala come bust as the host come reduce to ten men sake of say Bright Onyedikachi do im own back against Fuad Ekelojuoti.

 

The result go keep Kabiru Dogo and im boys two places above relegation water with 20 points from 16 matches and D m go welcome Wikki Tourists next for in side Akure on match day 17.

 

Photo credit – Sunshine Stars

If you use the quotes from this content, you legally agree to give www.brila.net the News credit as the source and a backlink to our story. Copyright 2024 Brila Media.

COMMENTS

WORDPRESS: 0

Imageboosterbn
WP Twitter Auto Publish Powered By : XYZScripts.com
error: Content is protected !!