No De Ligt for Barcelona

No De Ligt for Barcelona

Barcelona don comot hand as dem dey try land Juventus defender wey never settle wey be Matthijs de Ligt dis summer and na sake of the chacha tax scheme wey Italy carry come.

De Ligt £68million waka last summer bin see the Italo giants sharperly cash ontop the chacha law wey the Italian government bin pass for the beginning of 2019, where be say dem go tax only 50 per cent of the Holland international salary.

 

But sha o that benefit go remain if the player spend reach like a minimum of 24 months for the country, meaning say any waka go abroad before then go see the club dey liable to pay backdated tax ontop the rest of the 20-year-old annual £14.5m wage for that two-year period.

 

As a result any transfer go abroad in the case of De Ligt firt dey possible only starting from the month of July 2021. The problem go come up if the player waka leave go another club wey dey outside the Italian borders  but nothing go change if the player stay for Italy.

 

E get one release clause wey dey for De Ligt contract, were dem say dey around that kine £135m, but e no go kick in until June 2022 that is, three years enter inside im five-year deal.

If you use the quotes from this content, you legally agree to give www.brila.net the News credit as the source and a backlink to our story. Copyright 2024 Brila Media.

COMMENTS

WORDPRESS: 0

Imageboosterbn
WP Twitter Auto Publish Powered By : XYZScripts.com
error: Content is protected !!