Poland 2019 – USA kpokpo Naija to get hope

Poland 2019 – USA kpokpo Naija to get hope

Hangover Striker and USA U-20 player wey be Soto kolobi two goals to take helep the United States to kpake important U- 20 World Cup win over Nigeria.

The U.S. bin lose their opening  Kasala for Group D for  the World Cup with 2-1 defeat akpako  for the hand of  to Ukraine.Tab Ramos and im team know say if den no beat Naija no im be say e go put den for tight corner to take qualify for knockout stage of the competition.

 

Soto bin start  from the bench for the U.S  first game but against Naija coach Tab decide say e go dey useful against the Africans and e prove am with the two goals wey e score. E score first for the 18th minute, come add join for the second half.

 

Nigeria bin get penarity for the 64th minutes but after dem use Video Assistant Review to take check am, ref say na offside.

The U. ‘s dey third sake of goal difference but e no go hard dem to qualify becos Qatar MA team wey dem go fit beat and dis one go put den for better position.

 

Na the top two teams from the group go automatically qualify, but the four highest third-place finishers go also make am enter the knockout round.

If you use the quotes from this content, you legally agree to give www.brila.net the News credit as the source and a backlink to our story. Copyright 2024 Brila Media.

COMMENTS

WORDPRESS: 0

Imageboosterbn
WP Twitter Auto Publish Powered By : XYZScripts.com
error: Content is protected !!