FIFA Ranking: Naija na number three for Africa, 42nd for World

FIFA Ranking: Naija na number three for Africa, 42nd for World

The Super Eagles of Nigeria don crawl four places enter 42nd for the latest Fifa ranking wey the World governing join body bin release today. As e stand so Nigeria don become the third best team for Africa.

Senegal na number one for Africa but for world dem dey 23rd, Tunisia follow for 28th for World and second for Africa , then  Nigeria 42nd(3rd for Africa), Morocco 45th (4th for Africa) and Congo Democratic Republic 46th (5th for Africa) , others na Ghana 49th(6th) Cameroon 54th (7th) Egypt 57th (8th) Burkina Faso – 58th (9th) and Mali – 65th (10th na so dem take stand.

 

Three times African Champions Nigeria go dey hope to continue their ogbonge form so that dem no go fall down again for the next ranking.

 

Naija gather 1435 points to take dey dis position wey dem dey so for dis latest ranking.

 

Belgium na NUmber one for world, then world champions wey be France come follow as number two, others na Brazil (3) England (4)Croatia dey 5th.

If you use the quotes from this content, you legally agree to give www.brila.net the News credit as the source and a backlink to our story. Copyright 2024 Brila Media.

COMMENTS

WORDPRESS: 0

Imageboosterbn
WP Twitter Auto Publish Powered By : XYZScripts.com
error: Content is protected !!