Third bout go dey

Third bout go dey

Aproko wey dey according to the promoter Frank Warren tok say one agreement don already dey on ground for third fight between Tyson Fury and American wey be Deontay Wilder.

 

WBC heavyweight champion Wilder and Fury dey prepar for their rematch wey go shele for inside Las Vegas on Saturday after their first kasala bin end for controversial draw.

 

Warren tok say third bout clause don dey for the contract.According to am, the person wey lose out of the two boxers get only 30 days to call ontop the rematch and dem must accept the rematch.

 

Warren get confido say if Fury win, e dey better equipped to carry deal with the attention wey come as world champion wey e be than im bin dey after the Klitschko fight.

 

Fury still believe say na im kolobi their first fight wey shele for December 2018 for inside Los Angeles.

If you use the quotes from this content, you legally agree to give www.brila.net the News credit as the source and a backlink to our story. Copyright 2024 Brila Media.

COMMENTS

WORDPRESS: 0

Imageboosterbn
WP Twitter Auto Publish Powered By : XYZScripts.com
error: Content is protected !!