UEFA no happy with Turkey over salutes

UEFA no happy with Turkey over salutes

UEFA don announce say dem dey open disciplinary proceedings against Turkey sake of the potential provocative political behaviour wey their players bin show after dem make military salutes for their last two kasalas.

For both their Euro 2020 qualifiers against Albania and France, Turkish players bin make the salutes wey Uefa see as a way to carry show support for Turkey current military operation for inside Syria as dem celebrate late goals.UEFA tok say dem don appoint one ‘Ethics and Disciplinary Inspector’ to carry shook eye put for the matter.

 

On Friday for Istanbul, players bin throway salute after Cenk Tosun bin kolobi the only goal against Albania for the 90th minute. On Monday for Paris, dem still repaet am again after Kaan Ayhan bin equalize with nine minutes wey remain and again after ref blow the final whistle.

 

Earlier on Tuesday, Turkey sports minister Mehmet Muharrem Kasapoglu bin show support for players wey salute the country’s soldiers wen dem dey play their game for the Stade de France.

If you use the quotes from this content, you legally agree to give www.brila.net the News credit as the source and a backlink to our story. Copyright 2024 Brila Media.

COMMENTS

WORDPRESS: 0

Imageboosterbn
WP Twitter Auto Publish Powered By : XYZScripts.com
error: Content is protected !!