WADA wan shook eye put for Athletes

WADA wan shook eye put for Athletes

The World Anti-Doping Agency (WADA) don tok say dem go shook eye put for all the athletes wey train with banned coachee Alberto Salazar.

Dem bin find Salazar wey be the b4 b4 coachila of Britain Mo Farah guilty of doping violations after a four-year shook eye by the US Anti-Doping Agency.

 

The 61-year-old American tok say im go appeal against the ruling. Dem don close down the Nike Oregon Project (NOP) Salazar, bin dey run.

 

International Olympic Committee presido wey be Thomas Bach don tey tey tell Wada to shook eye put for the NOP athletes dem.

 

Dem bin establish the NOP wey base for Beaverton, Oregon for 2001 and na the home of four-time Olympic champion Farah.

If you use the quotes from this content, you legally agree to give www.brila.net the News credit as the source and a backlink to our story. Copyright 2024 Brila Media.

COMMENTS

WORDPRESS: 0

Imageboosterbn
WP Twitter Auto Publish Powered By : XYZScripts.com
error: Content is protected !!