Why Enrique comot hand for Spain job

Why Enrique comot hand for Spain job

Tori from inside Spain tok say Luis Enrique don comot hand say e no dey do again as Spain coach because of one serious family problem.

Na Luis Rubiales wey be the head of the Spanish Football Federation (RFEF) announce the permanent change on Wednesday.

 

Enrique binno dey for the game against Malta for March and other matches against San Marino and Sweden dis month. Tori say im number two wey be Robert Moreno go take over and e go keep the job ontop permanent basis.

 

Enrique don release statement dey thank im staff and the players for their professionalism and the media sake of say dem noyarn anyhow and the respect wey dem show for the situation.

 

Na after last World Cup Enrique bin take over the Spain team. Spain no reach the final four of the League of Nations but e kolobi the first Euro 2020 qualifier against Bosnia and the two friend friends against Wales and Bosnia.

If you use the quotes from this content, you legally agree to give www.brila.net the News credit as the source and a backlink to our story. Copyright 2024 Brila Media.

COMMENTS

WORDPRESS: 0

Imageboosterbn
WP Twitter Auto Publish Powered By : XYZScripts.com
error: Content is protected !!