Ahbegi Rohr no sabi work – Na Friday Elahor tok am

Ahbegi Rohr no sabi work – Na Friday Elahor tok am

With dis one wey Naija national head coachee Nnayi ukwu Gernot Rohr don release list of players wey go gbege Seychelles for the last Afcon group qualifier and Egypt for the friend friend kasala, B4 b4  Naija midfielder wey be Friday Elahor don tarsis Rohr sake of the way wey e carry dey invite different different players come the National team to take execute matches.

 

E provoke say upon all the 50 plus players wey e don invite, nnayi ukwu Rohr still never get regular players wey e fit say na im first eleven be dis.

E para say na total waste of money to dey invite all dis players from obodo oyibo to come play and at the end of the day na 14 go play, 3 for reserve and then the rest no go play , dem go still come share bonus.

 

E say the coach suppose carry players here join the foreign players instead of to dey invite different players wey dey play for different countries to come play matches.

 

Elahor say e no gree with wetin Rohr  tok say Naija players wey dey house no dey good enough to play for the National team.

Elahor come add join say e don look Rohr finish say the man no sabi work and e no fit carry naija football go anywhere.

 

E still insist say Rohr no get the liver for the work, say common friend friend gbege against Liberia, the man carry big players go play am. Apart from that, e say na the football authority im go blame wey give Rohr free hand to waka go house if e no get match instead of to dey monitor players for league.

 

E believe say if we National team must work then the coach must do im part.

If you use the quotes from this content, you legally agree to give www.brila.net the News credit as the source and a backlink to our story. Copyright 2024 Brila Media.

COMMENTS

WORDPRESS: 0

Imageboosterbn
WP Twitter Auto Publish Powered By : XYZScripts.com
error: Content is protected !!