Author: Jovita Eke

With dis one wey Naija national head coachee Nnayi ukwu Gernot Rohr don release list of players wey go gbege Seychelles for the last Afcon group qualifier and Egypt for the friend friend kasala, B4 b4  Naija midfielder wey be Friday Elahor don tarsis Rohr sake of the way wey e carry dey invite different different players come the National team to take execute matches. E provoke say upon all the 50 plus players wey e don invite, nnayi ukwu Rohr still never get regular players wey e fit say na im first eleven be dis. E para say na…

Read More

Grace Kurah wey be board member of  Nigeria Rugby football federation and sabi woman for women rugby don yarn say the Naija Ladies try wella for the Las Vegas women sevens wey dem go and where dem reach the quarterfinals. 1. Naija Invitation 42 vs 0 New Mexico U 2. Naija Invitation 5 vs 25 Phoenix 3. Naija Invitation 15 vs  17 Chicago Lions Black Quarterfinal against Rocky Mountain end 12-17. Grace tok say the koko now na sponsorship dem need to helep dem achieve something. Before the Las vegas Women sevens, the last time our Women participate…

Read More

Tori wey dey say if everything go well Clubs and Management of the  Nigerian National League wey be the NNL go hold Congress and Draw to carry welcome the chacha season. Dis one go shele dis  Wednesday 6th of March for inside Abuja. The AGM dey give people wey get hand for Naija football for dis level, better platform to sidon and discuss the plans and the programmes wey NNL get for the year. Media officer wey be Amar Ignis yarn say na for the Congress dem go gree whether the date wey dey on ground wey be the…

Read More

Mike Archer wey be the General Manager of the Nigeria Rugby Football Federation don React to the fact say dem no elect any Naija person for the Rugby Africa elections wey dem do. According to am, e say e no really matter say Naija person no dey among those wey dem elect, e say our priority now na how we go take put our house in order. E say Rugby na game wey dey grow for Niaja and for Africa. E add join say women rugby dey very important and say Naija women get plenty talents and get…

Read More

Olympic ’96 Gold Medalist for football and b4 b4 naija international Goalkeeper Dosu Joseph don congratulate and carry advice give the U-20 boys as dem dey ready for Poland 2019. E say preparation na the koko now and say if dem prepare well then dem go fit qualify from their group and even waka far for the tournament. As e take concern striker positions and goals for the team, e say the problem na general one all over the world. E say caoches suppose waka round the country to find better young strikers wey dey hungry enough to…

Read More

B4 b4 Super Eagles Eagles Midfielder Friday Elahor don come out to yarn concerning The NPFL and dis beating beating of Referees.  E say no be today dis one don start especially if e concern home game and e say we don mature pass to dey do dis kine thing, say time don reach for people to begin dey respect the law of football. According to Friday “if teams wey dey house prepare wella , no team go come ya house come beat you”. Instead of teams to ginger for house, na refs go come suffer am and na wrong…

Read More