Barcelona dey para for Ousmane Dembele

Barcelona dey para for Ousmane Dembele

Barcelona dey vex with Ousmane Dembele after the winger no show for one medical to carry check the extent of the injury wey e bin get for the yakata falling for  Athletic Bilbao hand.

Dembele bin play the whole 90 minutes for the 1-0 kondo  yakata for La Liga opening fixture on Friday night, but e come be like say e no too get himself as e waka comot for pitch after the game.

 

As tori come dey Barcelona bin dey expect Dembele to come hospital on Saturday morning to carry check the muscle problem, but e no show until Monday.

 

When dem finally check-am e come show say Dembele bin suffer tear to im left hamstring and dis one now go see am out of action for five weeks.

 

Barcelona don already dey worry as per the 22-year-old attitude like last season. Ousmanne injury now don leave Barcelona short of attacking options dem especially as Lionel Messi and Luis Suarez no sure.

If you use the quotes from this content, you legally agree to give www.brila.net the News credit as the source and a backlink to our story. Copyright 2024 Brila Media.

COMMENTS

WORDPRESS: 0

Imageboosterbn
WP Twitter Auto Publish Powered By : XYZScripts.com
error: Content is protected !!