Bayern bin wan kpake Havertz

Bayern bin wan kpake Havertz

Bayer Leverkusen sporting director wey be Rudi Voller don confirm say Bayern Munich bin ask about kpakeing Kai Havertz dis summer.

The German champions name don link wella with the 20-year-old midfielder as tori for June claim say dem don make one €90 million (£82m/$100m) offer for am even though say Barcelona, Liverpool and Manchester United among others dey eye am too.

 

After the club rubbish the waka, Havertz come confirm say im go like stay for July when e bin insist say im go surely spend the season for Leverkusen and later tok say im no dey sure if Bayern go be the correct destination for am.

 

And Voller don tok say im receive plenty calls about the Germany international throughout the summer transfer window, including one call wey e receive from Bayern CEO Karl-Heinz Rummenigge.

If you use the quotes from this content, you legally agree to give www.brila.net the News credit as the source and a backlink to our story. Copyright 2024 Brila Media.

COMMENTS

WORDPRESS: 0

Imageboosterbn
WP Twitter Auto Publish Powered By : XYZScripts.com
error: Content is protected !!