Ben Arfa carry PSG go court

Ben Arfa carry PSG go court

The fallout of Hatem Ben Arfa legal battle with Paris Saint-Germain show say im bin collect one bonus sake of say e no badmouth or tarsis the club publicly and e come training early.

Ben Arfa dey currently carry the French giants go court for  £7million sake of say dem comot am for setting from the club during the majority of im two-year waka for there.

 

Ben Arfa bin dey around for the hearing for Prud’hommes de Paris court as part of the litigation case. Na on December 16 dem go hear a decision ontop the outcome. During dis week hearing dem breakdown the salary of Ben Arfa.

 

According to tori from France e go kolobi gross monthly salary wey reach £434,000 wey dem go divide into two parts. This one go involve kpogiri wey dey £369,000-per-month join one ethics premium of £65,000.

 

Dem go pay dis ethics premium out if the France international meet some kine objectives for the club.Dis one include to dey come training on time and make e no tok bad of the club give the media.

 

Ben Arfa lawsuit with PSG shele sake of say the team no carry am join body for the first-team between April 2017 and June 2018.

If you use the quotes from this content, you legally agree to give www.brila.net the News credit as the source and a backlink to our story. Copyright 2024 Brila Media.

COMMENTS

WORDPRESS: 0

Imageboosterbn
WP Twitter Auto Publish Powered By : XYZScripts.com
error: Content is protected !!