Boris Becker para for Smallie men tennis Players

Boris Becker para for Smallie men tennis Players

With dis one wey young players no fit kolobi grand slam for the hand of oldies dem for major tournaments, b4 b4 grand slam winner wey be Boris Becker don come out to provoke for dis young players after Rafael Nadal kpake im 12th French Open.

Tennis Legends wey be Boris Becker and John McEnroe dey among those wey no understand how players like Rafael Nadal, Roger Federer and Novak Djokovic fit still dey kpake Grand Slam titles between themselves with the age wey dem dey, dem hold 53 overall and dem share the last 10 and dem dey dominate tey tey.

 

Dem don dominiate for long and na only Dominic Thiem don manage to reach final two times where Nadal carry Better akpako samma am.

 

Dominic Thiem na the only active player wey dey under the age of 28 to reached a major final. Becker say dis one no be good thing for players wey dey Under 28 as e question  the quality and attitude of players wey fall under dis age bracket.

 

According to Becker, dis one pass technical factors.E say e get the kine mentality wey Nadal, Federer and Djokovic get wey dis young players n get but  e say im go like see smallie players like Stefanos Tsitsipas and Dominic kpokpoing them when dem still dey very good.

If you use the quotes from this content, you legally agree to give www.brila.net the News credit as the source and a backlink to our story. Copyright 2024 Brila Media.

COMMENTS

WORDPRESS: 0

Imageboosterbn
WP Twitter Auto Publish Powered By : XYZScripts.com
error: Content is protected !!