Cameroon don ready to jam England for round of 16

Cameroon don ready to jam England for round of 16

Cameroon player Ajara Nchout kolobi two ogbonge goals wey include injury-time winner, as the Lionesses kpokpo New Zealand 2-1 to waka enter the last 16 of the World Cup as one of the best third-placed team.

Dem bin dey waka comot the tournament after Aurelle Awona go score for her own net with 10 minutes wey remain wey come make am 1-1.

 

Even though say Cameroon finish ontop three points, the same as Nigeria from Group A, dem waka enter round of 16 sake of say dem score one more goal pass  (3)their African sister dem.

 

Na the Netherlands top Group E with 100% record after dem nack Canada 2-1 akpako and go now play Japan while Canada wey finish for second place go jam either USA or Sweden.

If you use the quotes from this content, you legally agree to give www.brila.net the News credit as the source and a backlink to our story. Copyright 2024 Brila Media.

COMMENTS

WORDPRESS: 0

Imageboosterbn
WP Twitter Auto Publish Powered By : XYZScripts.com
error: Content is protected !!