Corona Virus: Ludogrets players ready come Italy

Corona Virus: Ludogrets players ready come Italy

Tori wey dey say Ludogorets Players bin wear face masks and protective gloves as dem waka enter inside Italy to face Inter for the Europa League gbege.

The coronavirus bin break out for inside northern Italy and e don affect the sporting calendar, as dem don postpone four Serie A matches last week and five games dis weekend go shele behind-doors wey dey closed.

 

Even sef Italy Six Nations kasala against Ireland for Dublin wey suppose shele on March 7 don postpone.

 

Tori say Ludogorets players no dey take any chances as dem waka enter the Italo city as de dey ready for their last-32 second-leg tomorrow.

 

Latest statistics show say 322 cases and 11 deaths don dey from coronavirus for inside Italy, and dis one go be the most for Europe by some distance dem.

If you use the quotes from this content, you legally agree to give www.brila.net the News credit as the source and a backlink to our story. Copyright 2024 Brila Media.

COMMENTS

WORDPRESS: 0

Imageboosterbn
WP Twitter Auto Publish Powered By : XYZScripts.com
error: Content is protected !!