Covid-19: Maldini don give update on im health

Covid-19: Maldini don give update on im health

AC Milan legend wey be Paolo Maldini don give update after e bin test positive for coronavirus as e yarn say im believe say im don pass through the worst of am.

Maldini bin feel the first symptoms of the disease on March 5 and Milan con reveal last week say both the b4 b4 Italy international and im pikin wey be Daniel don test positive for the Virus.

But the 51-year-old now don suggest say even though say him still get some of the symptoms, i dey good position.

 

Maldini  wey bin kolobi  the Champions League five times and Serie A seven times bin para hit out ontop the decision to continue to dey play matches as the coronavirus situation continue to dey develop across Europe.

According to am e say dem suppose to don stop Football since before e worse so.E say to dey play for the back of doors wey dem close na  violence, for the fans and the footballers dem.

If you use the quotes from this content, you legally agree to give www.brila.net the News credit as the source and a backlink to our story. Copyright 2024 Brila Media.

COMMENTS

WORDPRESS: 0

Imageboosterbn
WP Twitter Auto Publish Powered By : XYZScripts.com
error: Content is protected !!