Diamond League Organizers invite Semenya come Rabat

Diamond League Organizers invite Semenya come Rabat

Organisers tok say dem don invite Caster Semenya to come run for the 800m for Sunday Diamond League Meeting for Rabat.

Na dis week the Swiss Federal Supreme Court bin suspend the IAAF chacha rules wey wan stop testosterone levels for woman athletes like Semenya.

Even though say dem don clear am to continue to dey run, Semenya don come out to yarn say dem no allow her run for Morocco.

But for the meeting wey dem hole on Friday, organiser Alain Blondel tok say e totori am to confirm say dem invite Semenya.

Semenya aleady get ongoing legal appeal against the IAAF decision to carry stop testosterone levels wey go affect athletes wey get differences of sexual development (DSD).

Even with all dis legal kasala,the double Olympic Champion name already dey South Africa preliminary squad for the World Championships wey go shele for inside Qatar later dis year.

If you use the quotes from this content, you legally agree to give www.brila.net the News credit as the source and a backlink to our story. Copyright 2024 Brila Media.

COMMENTS

WORDPRESS: 0

Imageboosterbn
WP Twitter Auto Publish Powered By : XYZScripts.com
error: Content is protected !!