Federer still dey pursue gold

Federer still dey pursue gold

Roger Federer don announce say im go compete for next year Tokyo Olympics as e dey try see wether im go fit kolobi the men’s singles gold medal wey be the only major prize wey e never still kpake.

Federer don kolobi all four of the Grand Slam tournaments join the ATP Tour Finals wey e don kpake six times, but e still dey find how to kolobi the Olympic singles gold.

 

The 20-time Grand Slam champion don win one doubles gold together with im fellow Swiss wey be Stan Wawrinka for Beijing for 2008, but when e reach the London singles final for 2012 e chop am 6-2, 6-1, 6-4 for Andy Murray hand.

 

Federer bin no show for Rio 2016.Serbia Djokovic, and im rival Rafael Nadal, don come out to tok say dem go compete for Tokyo and now the three players don set the scene for highly competitive tournament.

If you use the quotes from this content, you legally agree to give www.brila.net the News credit as the source and a backlink to our story. Copyright 2024 Brila Media.

COMMENTS

WORDPRESS: 0

Imageboosterbn
WP Twitter Auto Publish Powered By : XYZScripts.com
error: Content is protected !!