FIFA and FIFpro wan protect players

FIFA and FIFpro wan protect players

Fifa and Fifpro  wey be the world players union join body don set up one global fund to take protect players salaries dem.

 

The Fifa Fund for Football Players (Fifa FFP) go dey give financial support to players wey their clubs no pay and no go pay.

 

World governing join body Fifa don put aside kpogiri wey reach  $16m (£12.3m) for the fund go reach 2022, divide am into yearly allocations.

 

Another $5m (£3.8m) na im dem don also  allocate for players wey dey affected between July 2015 and June 2020.

 

For 2019, Fifa bin update their  disciplinary code to carry improve the framework to take dey deal with the non-payment of players salaries dem.

 

Dem tok say if one club  no gree pay the player at least two month salaries when dem suppose pay, the player go fit get reason to terminate im contract.

 

Dem go launch the chacha fund on  July 1.

If you use the quotes from this content, you legally agree to give www.brila.net the News credit as the source and a backlink to our story. Copyright 2024 Brila Media.

COMMENTS

WORDPRESS: 0

Imageboosterbn
WP Twitter Auto Publish Powered By : XYZScripts.com
error: Content is protected !!