FIFA don release Puskas Award Nominees

FIFA don release Puskas Award Nominees

Zlatan Ibrahimovic, Lionel Messi, and Andros Townsend dey among the 10 players wey Fifa don nominate for the ogbonge  2019 Puskas Award.

FIFA don expose their shortlist of the goals wey dem feel say be the best over the course of the last 12 months. Some big names and ogbonge strikes dey among the runners and riders.

 

Barcelona superstar Messi makes the list sake of im clever chip during the kasala with Real Betis.

 

Ibrahimovic wey dey play for LA Galaxy dey ontop list sake of im goal against Toronto FC.Townsend bin ginger for the Premier League meeting between Crystal Palace and Manchester City with one spectacular drive from a far distance.

 

Sampdoria frontman wey be Fabio Quagliarella na another player wey dey the list, Also  Matheus Cunha wey dey play for RB Leipzig dey for im strike against Bayer Leverkusen.

 

Na three women make the list , Achara NcoAjara Nchout (Cameroon v New Zealand, Fifa Women’s World Cup – 20 June 2019)Amy Rodriguez (Utah Royals v Sky Blue FC – 16 June 2019) and Billie Simpson (Cliftonville Ladies v Sion Swifts – 9 August 2018).

 

Puskas Award nominees

Matheus Cunha (RB Leipzig v Bayer Leverkusen – 6 April 2019)

Zlatan Ibrahimovic (LA Galaxy v Toronto FC – 15 September 2018)

Lionel Messi (Barcelona v Real Betis – 17 March 2019)

Ajara Nchout (Cameroon v New Zealand, Fifa Women’s World Cup – 20 June 2019)

Fabio Quagliarella (Sampdoria v Napoli – 2 September 2018)

Juan Fernando Quintero (River Plate v Racing Club – 10 February 2019)

Amy Rodriguez (Utah Royals v Sky Blue FC – 16 June 2019)

Billie Simpson (Cliftonville Ladies v Sion Swifts – 9 August 2018)

Andros Townsend (Crystal Palace v Manchester City – 22 December 2018)

Daniel Zsori (Debrecen FC v Ferencvaros – 16 February 2019)

If you use the quotes from this content, you legally agree to give www.brila.net the News credit as the source and a backlink to our story. Copyright 2024 Brila Media.

COMMENTS

WORDPRESS: 0

Imageboosterbn
WP Twitter Auto Publish Powered By : XYZScripts.com
error: Content is protected !!