Football agent dey accuse Ferguson

Football agent dey accuse Ferguson

Tori say one football agent wey dem accuse of corruption don come out to claim say b4 b4 Manchester United Coach wey be Sir Alex Ferguson bin conspire to fix one match between Manchester United and Juventus and e bin collect Rolex gift watch wey reach £30,000, na so one court hear today.

Giuseppe ‘Pino’ Pagliara na one of two football agents wey dey on trial together with b4 b4 Barnsley assistant coachee wey be Tommy Wright. All the three don deny bribery.

 

One Jury for Southwark Crown Court bin hear say dem charge the three following some kine yarn from one media house wey bin lead to wetin make Sam Allardyce resign as England manager.

 

As part of the prosecution case wey dem carry come, the court hear of claims wey dem no fit prove wey Pagliara make about b4 b4 Premier League managers when the agent bin meet with one  undercover reporter wey bin dey pose as businesswoman.

 

Prosecutor Brian O’Neill QC tok say e reach one level Pagliara  come dey yarn bitterly about the b4 b4 Manchester United manager Sir Alex Ferguson as e accuse am of conspiring to fix the result of one Champions League match against Italian side Juventus.

If you use the quotes from this content, you legally agree to give www.brila.net the News credit as the source and a backlink to our story. Copyright 2024 Brila Media.

COMMENTS

WORDPRESS: 0

Imageboosterbn
WP Twitter Auto Publish Powered By : XYZScripts.com
error: Content is protected !!