Guinea FA Boss don give him players ginger to go beat Eagles

Guinea FA Boss don give him players ginger to go beat Eagles

Presido of the Guinea Football Federation (FGF) wey be  Antonio Souare, don charge the national team say make dem do everything wey be say dem fit to kpokpo Nigeria, as dem dey target chance for the final of the 2019 Africa Cup of Nations.

Guinea bin try but only fit manage to draw  2-2 draw with Madagascar for their first kasala for Group B and now dem need to kpake win against the Super Eagles of Nigeria on Wednesday to carry increase their chance of wakaring to the knockout stage of the competition.

 

As dem dey count down to the gbege  wey go shele for inside the Alexandra Stadium, Souare come waka go visit the team camp to carry remind Paul Put and im boys  of how important their waka for Egypt dey for the West African country.

 

Guinea dey second for Group B standings with one point after their first game and dem dey two points for the back of leaders Nigeria.

If you use the quotes from this content, you legally agree to give www.brila.net the News credit as the source and a backlink to our story. Copyright 2024 Brila Media.

COMMENTS

WORDPRESS: 0

Imageboosterbn
WP Twitter Auto Publish Powered By : XYZScripts.com
error: Content is protected !!