I fit comot tennis if…- Nadal

I fit comot tennis if…- Nadal

Rafael Nadal don tok one kine say im fit Waka leave tennis if im feel say im no go fit play for high level, though the world No 2 believe say im fit still kolobi more titles.

Nadal bin crash comot Madrid Open semi-final after e fall yakata 6-4, 2-6, 6-3 to Greek world No 9 wey be Stefanos Tsitsipas, and dis one follow another last-four yakata falling for im last two events for Barcelona and Monte Carlo.

 

Dis one wey Nadal dey fall like dis for clay court event dem don make people dey look am one kine as to whether e go fit to dominate again for clay,  as  e don Dey do for the past 15 years.

 

Now Nadal go Waka enter Rome for the Italian Open , where im  be the defending and eight-time champion and e go dey hope to kpake im first clay title dis year before im go enter  Roland Garros to defend im crown.

 

Nadal say kpakeing record 12th French Open title na there im mind and focus dey on top.

 

But after e no start well ontop clay last month after another knee injury, Nadal dey hope say im go recover quick and if im  no dey at im best,   naim be say e fit Waka leave tennis.

If you use the quotes from this content, you legally agree to give www.brila.net the News credit as the source and a backlink to our story. Copyright 2024 Brila Media.

COMMENTS

WORDPRESS: 0

Imageboosterbn
WP Twitter Auto Publish Powered By : XYZScripts.com
error: Content is protected !!