I no need Zlatan – Mourinho

I  no need Zlatan – Mourinho

Tottenham Hotspurs chacha manager wey be Jose Mourinho don tok say Tottenham no go kpake Zlatan Ibrahimovic come the club for as e yarn say need no dey sake of say im get the best striker for England wey be Harry Kane.

Ibrahimovic go dey available ontop oshofree transfer for new year when e go complete im two-year waka for MLS side LA Galaxy.

 

 

Mourinho wey yarn before im side Champions League kasala against Olympiacos on Tuesday, insist say need no dey for the b4 b4  Manchester United forward for im team sake of say Kane quality.

 

Mourinho bin kolobi Ibrahimovic ontop oshofree transfer for 2016 when im bin dey for Manchester United and the Swede come produce ogbongelicious return as e kpake 29 goals for the 53 times wey e appear for the Manchester Club.

If you use the quotes from this content, you legally agree to give www.brila.net the News credit as the source and a backlink to our story. Copyright 2024 Brila Media.

COMMENTS

WORDPRESS: 0

Imageboosterbn
WP Twitter Auto Publish Powered By : XYZScripts.com
error: Content is protected !!