Keita don join Guinea team for Marrakech Training base

Keita don join Guinea team for Marrakech Training base

Naby Keita don join im Guinea training camp for Marrakech after im e kolobi the 2018-19 Uefa Champions League title with im club Liverpool.

Na injury make Keita no play for the final against Tottenham Hotspur for Madrid,but the  midfielder wey dey ginger bin play big part for the Reds waka during the season, e even kolobi three goals before e woundjor.


 

Keita don tok say true true im no dey fully fit for the Africa Cup of Nations but coachila wey be Paul Put still include am join for im final squad for the competition for Egypt.

 

As e enter Morroco, the entire Guinea team team and the coaching crew happy wella say the 24-year-old  come join dem.

Guinea dey Group B and dem go begin their waka for Egypt with their first kasala Madagascar on June 22.Nigeria and Burundi dey the group too.

If you use the quotes from this content, you legally agree to give www.brila.net the News credit as the source and a backlink to our story. Copyright 2023 Brila Media.

COMMENTS

WORDPRESS: 0
Comodo SSL SiteLock
WP Twitter Auto Publish Powered By : XYZScripts.com
error: Content is protected !!