Madrid hand dey there

Madrid hand dey there

Italy defender wey be Giorgio Chiellini don come out to accuse and tasis Real Madrid say dem rig last year Ballon d’Or as e claim say dem stop Cristiano Ronaldo from kolobing the award.

Ronaldo bin complete im £100million waka go Juventus for 2018 summer transfer window before e come finish as runner-up for the Ballon d’Or voting for the back of Luka Modric.

Na on Monday dem bin crown Lionel Messi as dis year winner,as e kpake the ogbonge award for a record sixth time and waka pass Ronaldo kolobi of five titles.

The Portuguese star no show at all for the party wey shele for Paris as e dey house for Italy to collect im Serie A player of the year gong for the Gran Gala awards for inside Milan.

Na for the event Chiellini come para dey defend im Juventus team-mate as e claim say Real Madrid bin want make their own player win.

Even though say the Italian defender believe say Ronaldo suppose win the award last year, but e gree say Messi deserve  to kpake this year own.

If you use the quotes from this content, you legally agree to give www.brila.net the News credit as the source and a backlink to our story. Copyright 2024 Brila Media.

COMMENTS

WORDPRESS: 0

Imageboosterbn
WP Twitter Auto Publish Powered By : XYZScripts.com
error: Content is protected !!