Make una work harder for super six – Ex-RANGERS star tell current players

Make una work harder for super six – Ex-RANGERS star tell current players

B4 b4 Rangers international players Don come out to hail the Seven-time Nigeria league champions and reigning FA cup champions wey be Rangers International F.C sake of say dem kolobi ticket for the end of season Super-Six playoff.

 

Dem don tell dem to dey focused and  to work hand join so that den go fit kpake the  league for the 8th time .

 

The umbrella join body of the club former players wey be Ex-Rangers International Footballers Association yarn dis one for their  monthly meeting for  Enugu on tuesday, May 28, 2019.

 

Secretary of the association wey be  Edmond Ndukamma wey yarn on behalf of the chairmo wey be  Prince Davidson Owumi, tok say the Waka of the current  squad for both continental and domestic gbeges totori the association wella but e say dey go gat to work harder for the play off to take become the champion of the 2018/2019 league season.

 

The b4 b4 defender say the association happy with wetin chairmo and the general manager of Rangers, Prince Davidson Owumi don achieve for  the club with im contribution. E also salute the  Enugu state executive governor, Rt. Hon. (Dr.) Ifeanyi Ugwuanyi for im financial and moral support to the club and association.

 

Enugu Rangers dey group A of the Super six together with Lobi Stars and Enyimba International. While group B get Akwa United,  Kano Pillars and FC Ifeanyi Ubah.

 

Group A:

1. Rangers Int’l

2. Lobi Stars

3. Enyimba Int’l

 

Group B:

4. Akwa Utd

5. Kano Pillars

6. FC Ifeanyi Ubah.

If you use the quotes from this content, you legally agree to give www.brila.net the News credit as the source and a backlink to our story. Copyright 2024 Brila Media.

COMMENTS

WORDPRESS: 0

Imageboosterbn
WP Twitter Auto Publish Powered By : XYZScripts.com
error: Content is protected !!