Mbappe dey 200 per cent with PSG

Mbappe dey 200 per cent with PSG

According to wetin  sporting director Leonardo tok, Kylian Mbappe na top priority for Paris Saint-Germain, even though say the Brazilian no believe say im dey any position to promise club supporters say their smallie star go stay for Paris. 

Mbappe future with the club no dey clear as yarn don dey concerning am dis summer.  The 20-year-old bin start aproko early for summer wen e bin claim say im dey look for chacha project and im name come link to Real Madrid and im name still dey fly up and down since then.

PSG don try comot shook eye for Mbappe side and dem don come out to tok say the player go still dey 200 per cent part of the club wen next season go start.

Mbappe bin score 33 goals for Ligue 1 last season, come finish as the division top scorer, 11 goals clear of Lille Nicolas Pepe.

If you use the quotes from this content, you legally agree to give www.brila.net the News credit as the source and a backlink to our story. Copyright 2024 Brila Media.

COMMENTS

WORDPRESS: 0

Imageboosterbn
WP Twitter Auto Publish Powered By : XYZScripts.com
error: Content is protected !!