Mbappe dey wait

Mbappe dey wait

Tori say Paris Saint-Germain star Kylian Mbappe dey wait until season end before  e go make any decisions as e take concern im future.

The French champions dey desperate to carry rope tie the 20-year-olddown pass im current deal wey go run go reach 2022 so that dem go fit comot the shook eyes of Real Madrid from im body.

 

According to tori from France the Frenchman go instead weigh im options once the current campaign finish.

 

E don tey wey the Spanish Giants dey eye Mbappe and belief dey say the French forward go finally make im movement go the Santiago Bernabeu for summer.

 

The 20-year-old bin sign for PSG from Monaco for the summer of 2017 for inside deal wey reach £166million, an dis one come make am the second most expensive player behind im team-mate wey be Neymar.

If you use the quotes from this content, you legally agree to give www.brila.net the News credit as the source and a backlink to our story. Copyright 2024 Brila Media.

COMMENTS

WORDPRESS: 0

Imageboosterbn
WP Twitter Auto Publish Powered By : XYZScripts.com
error: Content is protected !!