More injuri wahala for Neymar

More injuri wahala for Neymar

Tori say Neymar no go play for the Copa America after e wound for ankle for Brazil friend friend gbege with Qatar.

Neymar bin Waka comot after 21 minutes after one quatari Player tackle am anyhow wey come make am wounjor im ankle.

 

The Brazilian Football Confederation (CBF) don confirm the news and  E dey Pain demands say the PSG star wey  be one of  their ogbonge players for team no go dey the tournament wey dey dey host.

 

E bin start for front together with Richarlison and Gabriel Jesus. The friend friend gbege na to helep  Brazil preparations for dis summer tournament for South America.

 

Even before Neymar wound sef , the CBF vice-Presido wey be Francisco Noveletto don tok say Neymar fit no play for the Cops America sake of the rape matter wey concern am.

 

As if dat one no do,  dem collect captaincy for im hand carry give Dani Alves as person wey go lead dem for the tournament.

If you use the quotes from this content, you legally agree to give www.brila.net the News credit as the source and a backlink to our story. Copyright 2024 Brila Media.

COMMENTS

WORDPRESS: 0

Imageboosterbn
WP Twitter Auto Publish Powered By : XYZScripts.com
error: Content is protected !!