Na Battle of the Stars as Ghana, Kenya jam for 2019 Afcon qualifiers

Na Battle of the Stars as Ghana, Kenya jam for 2019 Afcon qualifiers

With dis one wey the continent dey ready to play the final AFCON qualifiers, tori wey dey come out from inside Ghana tok say coachee Kwesi Appiah  wan bring ogbonge team wey consist of foreign base players dem  go play for the kasala against Kenya for the Final group F gbege wey go shele on March 22 for inside Accra.

 

According to yarn, dis one don turn to revenge mission sake of say Kenya kpokpo the black stars  1-0 kondo for inside Nairobi last year  September and as e dey so, dem ready to die there for the second leg.

 

Meanwhile, aproko five players dey ready to kpake their first cap for the Black stars and dis five include two players from Ghanaian side Asante Kotoko wey be Amos Frimpong and GK Felix Anan, even Joseph Aidoo wey dey play for Belgium go follow kpake cap that day.

 

Skippo Asamoah Gyan and Daniel Amartey no go play sake of say dem don wound but tok tok wey dey say na Andre Ayew wey dey play for Fenerbahce of Turkey na im go lead the team go gbege against Kenya .

 

Kenya dey top the group with 7 points while Ghana follow am for back with 6points. The Harambee stars don tok say dem sef no go sleep so na we die there be the koko now.

If you use the quotes from this content, you legally agree to give www.brila.net the News credit as the source and a backlink to our story. Copyright 2024 Brila Media.

COMMENTS

WORDPRESS: 0

Imageboosterbn
WP Twitter Auto Publish Powered By : XYZScripts.com
error: Content is protected !!