Na Discipline go determine Ghana waka for Afcon

Na Discipline go determine Ghana waka for Afcon

B4 b4 Ghana international wey be John Paintsil tok say tactical discipline ontop pitch go follow determine how far the Black Stars waka go be for the Africa Cup of Nations (Afcon).

The Black stars go dey hope to end their their bad Market for the continental championship as dem don make am reach the semi-final of the last six tournaments but dem still no kolobi the trophy.

 

Ghana go jam defending champions wey be Cameroon, Benin and Guinea-Bissau for the group stage.

 

According to begin Paintsil yarn,e say with determination, hard work, confidence, teamwork, respect and if the coach dey there for the players and players dey there for coach , e say dem go finish work for Egypt.

 

E also tok say the players need to maintain discipline and positional play  ontop pitch, dem gat to listen and play to instruction.

 

Ghana don kolobi the Afcon Four-times  and the las time wey their hand touch am na for Afcon for 1982. The black stars go begin their 2019 Afcon waka against Benin on June 25, come jam Cameroon and Guinea-Bissau on June 29 and July 2.

If you use the quotes from this content, you legally agree to give www.brila.net the News credit as the source and a backlink to our story. Copyright 2024 Brila Media.

COMMENTS

WORDPRESS: 0

Imageboosterbn
WP Twitter Auto Publish Powered By : XYZScripts.com
error: Content is protected !!