Na wa o! Dem don shift NNL season again?

Na wa o! Dem don shift NNL season again?

After postponement upon postponement, tori wey dey now say the Nigeria National league don shift go 3rd of April wey be Wednesday.

The format go still dey the same abridged divisions of A1,A2 and B1, B2 for the North and South regions of Naija and na Forty-two teams go show for the 2019 NNL gbege season.

Sake of say many clubs never still obey the registration formalities, the draws for the chacha season no go hold and the people wey dey in charge of NNL  don carry 7 days grace samma clubs wey never comply.

 

Tok wey dey say the draws go hold on Monday 25, March 2019.

Meanwhile, aproko wey dey on ground say the Title sponsors of the League, wey be Bet9ja don comot hand for the League after two(2)years wey dem don dey support the NNL. Dem say dem no dey do again.

 

As e take dey so na 4 teams wey kpake the abridged divisions go qualify straight enter the Naija Professional Football League( NPFL) and after everything, dem go hole the super four for one center to take determine who the overall champion of the NNL for the season be.

The Super four gangan go shele for the Stephen Keshi Stadium, Asaba Delta State.

If you use the quotes from this content, you legally agree to give www.brila.net the News credit as the source and a backlink to our story. Copyright 2024 Brila Media.

COMMENTS

WORDPRESS: 0

Imageboosterbn
WP Twitter Auto Publish Powered By : XYZScripts.com
error: Content is protected !!