Nigeria under 19 handball male team on Sunday fall yakata to Chinese Taipei for the final of the IHF International Trophy Challenge for inside Prestina, Republic of Kosovo.
The coach Emeka Joseph Nnamani cadet team try drag am but finally their power no reach at dem lose 27-26 to Chinese Taipei to take kolobi silver for the competition.
Alhaji Maigidasanma Mohammed wey be the Secretary-General of the Handball Federation of Nigeria don hail the team for their ginger and the way wey dey carry represent the country wella.
COMMENTS