NNL Annual General Meeting/Draw go hold dis Wednesday

NNL Annual General Meeting/Draw go hold dis Wednesday

Tori wey dey say if everything go well Clubs and Management of the  Nigerian National League wey be the NNL go hold Congress and Draw to carry welcome the chacha season. Dis one go shele dis  Wednesday 6th of March for inside Abuja.

 

The AGM dey give people wey get hand for Naija football for dis level, better platform to sidon and discuss the plans and the programmes wey NNL get for the year.

 

Media officer wey be Amar Ignis yarn say na for the Congress dem go gree whether the date wey dey on ground wey be the 13th of March go fit stand and the format wey the league go take for the season wey dey come so…

NNL wey be the second tier of Naija football bin adopt the abridged format of four groups -A1,A2 and B1,B2 of ten(10)clubs for each group wey come total forty (40) teams last season.

If you use the quotes from this content, you legally agree to give www.brila.net the News credit as the source and a backlink to our story. Copyright 2024 Brila Media.

COMMENTS

WORDPRESS: 0

Imageboosterbn
WP Twitter Auto Publish Powered By : XYZScripts.com
error: Content is protected !!