Ramsey go miss Wales kasala

Ramsey go miss Wales kasala

Juventus midfielder Aaron Ramsey go miss Wales international gbege against Azerbaijan and Belarus.

Na the Football Association of Wales make dis announcement Tuesday, though dem no give any reason at all. Many believe say Ramsey absence fit be becos say im lack match fitness.

 

The 28-year-old don make only one full appearance since April after e woundjor im hamstring for b4 b4 club Arsenal.

 

Ramsey bin miss Juventus season kasala with Parma after e spend the summer dey recover from the hamstring injury wey e get.

 

E bin play 15 minutes of one pre-season friend friend against Triestina but e never still make im first-team debut.

If you use the quotes from this content, you legally agree to give www.brila.net the News credit as the source and a backlink to our story. Copyright 2024 Brila Media.

COMMENTS

WORDPRESS: 0

Imageboosterbn
WP Twitter Auto Publish Powered By : XYZScripts.com
error: Content is protected !!