See photos as Shooting Stars arrange medical for all dem boys

See photos as Shooting Stars arrange medical for all dem boys

Aproko wey dey say 3SC players don do medicals to make sure say dey better  state of health. Dem do this one for the one medical Center for Ibadan.
Rasheed  Valium wey be the General Manager of the Oluyole Warriors too say the reason wey make dem do the medical checkup was to make sure say the boys dey better shape both mentally and physically.

E say as the professional side we dem be, need dey for Shooting Stars to follow the standard for World. E say na Erin  make the management think am to arrangee the medical test for the players.

 

The Team Manager, Dimeji Lawal join the technical crew wey coachee Edith Agoye dey lead and all the players dey involve for  the comprehensive check up.

 

The whole tin totori head coachee Agoye and e feel say the work wey dey dem front big so all did  go help dem ready wella for the job.

 

The Ibadan warrior’s go jam  Giant Briller on Saturday for one NNL Group B1 Match Day Two encounter for Enugu.

If you use the quotes from this content, you legally agree to give www.brila.net the News credit as the source and a backlink to our story. Copyright 2024 Brila Media.

COMMENTS

WORDPRESS: 0

Imageboosterbn
WP Twitter Auto Publish Powered By : XYZScripts.com
error: Content is protected !!