See why Police Kpam Platini

See why Police Kpam Platini

B4 b4 UEFA presido wey be Michel Platini tok say im dey innocent of all the charges dem wey dem level against am. E yarn dis one after police ask am questions wey concern the awarding of the 2022 World Cup.

Dem kolobi Platini enter custody as part of the shook eye wey concern the awarding of the World Cup to Qatar, and hole am for the premises of the Anti-Corruption Office of the Judicial Police. Even with all dis one wey happen e still insist say im no do anything wrong.

 

Na for 2007 dem bin elect French legend Platini  and e serve as presido go reach 2015 when the FIFA Ethics Committee come carry akpako ban hammer am.

 

Now Tori say dem dey question am Nanterre, one small place for western Paris.

 

Tori say one of the reasons why dem arrest am na sake of the meeting wey shele 10 days before the ballot of FIFA for the World Cup decision for 2010, where b4 b4 France presido Nicolas Sarkozy bin invite Tamim bin Hamad al-Thani, Crown Prince of Qatar and Platini wey at that time be UEFA Presido and Vice Presido of FIFA come one meeting for the Elysee hotel.

If you use the quotes from this content, you legally agree to give www.brila.net the News credit as the source and a backlink to our story. Copyright 2024 Brila Media.

COMMENTS

WORDPRESS: 0

Imageboosterbn
WP Twitter Auto Publish Powered By : XYZScripts.com
error: Content is protected !!