Sharapova don retire

Sharapova don retire

Five-time Grand Slam champion wey be Maria Sharapova don say bye bye to tennis at the age of 32.

For inside one article, Sharapova bin tok say her body no gree am again say e don become distraction for her after she bin struggle with shoulder injuries.

 

The Russian bin kolobi her first Grand Slam for inside Wimbledon for 2004 wen she bin dey 17 years.

 

She come complete the career slam that is, all four major titles wen she kpake the French Open for 2012.

 

For 2016, she come serve one 15-month ban aftershe bin test positive for one substance wey dem dey call meldonium.

 

When she come back from that ban for 2017, Sharapova come begin dey struggle to recapture her before before best form and like say that one no do na so so injury she dey suffer.

If you use the quotes from this content, you legally agree to give www.brila.net the News credit as the source and a backlink to our story. Copyright 2024 Brila Media.

COMMENTS

WORDPRESS: 0

Imageboosterbn
WP Twitter Auto Publish Powered By : XYZScripts.com
error: Content is protected !!