South Korea fans don para wan sue Ronaldo

South Korea fans don para wan sue Ronaldo

Tori wey dey come out from Asia tok say Fans for South Korea wan take legal action to carry collect compensation after Cristiano Ronaldo no show for one friend friend kasala during Juventus’ pre-season tour for Seoul last week.

According to the people wey organise the pre-season gbege , dem bin contract Ronaldo to play for at least 45 minutes against K League All Stars but the player sidon for bench throughout the whole kasala for the Seoul World Cup Stadium wey pack full.

 

Dem don form one online community ontop South Korea Naver web portal to carry protest about Ronaldo lack of participation for the game and already two members don contact one lawyer wey im name na Kim Min-ki to file one lawsuit against the people wey organize the match.

 

The lawsuit dey find compensation of 70,000 won (£48) per ticket, 1,000 won for the ticket commission kpogiri (70p), and 1 million won (£696) each for compensation for wetin dem call ‘mental anguish’.

If you use the quotes from this content, you legally agree to give www.brila.net the News credit as the source and a backlink to our story. Copyright 2024 Brila Media.

COMMENTS

WORDPRESS: 0

Imageboosterbn
WP Twitter Auto Publish Powered By : XYZScripts.com
error: Content is protected !!