Sunshine Stars don get chacha Team Bus

Sunshine Stars don get chacha Team Bus

So that their waka for matches go dey go serewere and for players to gbadun their journey waka, the Ondo State Government don carry better chacha team bus samma Sunshine Stars FC players and officials dem. 

Na for weekend dem deliver the one unit chacha 33 seater bus give the  Club and na dat happiness totori dem, come ginger dem to kpokpo Kwara United for inside Akure for weekend.

The State Football Agency Chairmo, wey be Otunba Tajudeen Akinyemidon come hail Governor Rotimi Akeredolu government pipu for dis promise wey dem fulfil so.

According to am e say dis one show say the state government get the welfare of the players for mind and e believe say dis kine gesture go dey ginger the swagger of the players to do more to carry the club enter chacha levels.

If you use the quotes from this content, you legally agree to give www.brila.net the News credit as the source and a backlink to our story. Copyright 2024 Brila Media.

COMMENTS

WORDPRESS: 0

Imageboosterbn
WP Twitter Auto Publish Powered By : XYZScripts.com
error: Content is protected !!