Tennis player Nick Kyrgios inside Hot water

Tennis player Nick Kyrgios inside Hot water

Nick Kyrgios don land himself inside hot water wey hot wella after im first-round US Open kpake and e fit face suspension from the ATP Tour.

The Aussie bin come out to accuse the ATP  wey be the governing join body of men tennis say dem dey very corrupt sake of say dem carry kpogiri fine wey reach $113,000 samma am after wetin shele for for inside Cincinnati where e bin para tarsis umpire Fergus Murphy.

 

Dis wan bin happen Wen Kyrios bin play Against world No. 9 Karen Khachanov for the Masters 1000 event, and e come still waka comot from the court without permission to go smash two racquets.

 

As e dey waka comot from court,na so e spit for the direction of the umpire chair , come still call am the F word join tool’.

 

After im first-round US Open win against Steve Johnson, Kyrgios come open mouth tarsis ATP say dem dey pretty corrupt anyway.

 

The Australian fit no escape Suspension but the timing of the ban go dey very interesting. Kyrgios dey schedule to play for the Laver Cup wey be the brainchild of ATP golden boy Roger Federer for Geneva straight after dem play the US Open but dem fit no allow am play if e dey suspension sake of say the event go soon become official ATP event very soon.

If you use the quotes from this content, you legally agree to give www.brila.net the News credit as the source and a backlink to our story. Copyright 2024 Brila Media.

COMMENTS

WORDPRESS: 0

Imageboosterbn
WP Twitter Auto Publish Powered By : XYZScripts.com
error: Content is protected !!