Terkpetey make Ghanaians para for Coach Appiah

Terkpetey make Ghanaians para for Coach Appiah

Tori say Ghanaians dey para sake of say Bernard Terkpetey name no follow for  Ghana squad wey dey go the 2019 AFCON as dem don enter social media begin dey tarsis and question coachee Kwasi Appiah to come explain give dem why the striker no dey list. 

The Ghana coachee bin  name 29-man squad for the 3-week camping for inside Dubai as den dey prepare for the tournament wey go start on 21st June. Im go still reduce the squad go 23 for the tournament after the camping  Dubai.

The para wey ghanians dey para na sake of say the cha-cha Schalke 04 striker dey hot like fire for Germany where e dey ginger for SC Paderborn 07. E don  kolobi 11 goals for the 36 appearances wey e don make for Paderborn  and e don also give 7 assists.

The Ghanaian helep movea SC Paderborn 07  from the Bundesliga II go the Bundesliga but Ghana coachee Kwasi Appiahno even look im side instead e go invite strikers wey no even meet the kine level wey Terkpeteyreach did season.

Because of im ginger and swagger for SC Paderborn 07, Achilles 04 don sharperly okobi Terkpetey back for the 2019/20 season.

If you use the quotes from this content, you legally agree to give www.brila.net the News credit as the source and a backlink to our story. Copyright 2024 Brila Media.

COMMENTS

WORDPRESS: 0

Imageboosterbn
WP Twitter Auto Publish Powered By : XYZScripts.com
error: Content is protected !!